Thrilling Story of Emmanuel Onuigbo - Paul Pogba Look-a-like and Biggest Fan in Nigeria

 


(Story told in Pidgin English As Adapted from BBC Pidgin)  Watch Video

I be Paul Pogba biggest fan' dat na wetin one young footballer dey call imself.


Emmanuel Onuigbo wey be young Nigerian footballer say Pogba wey win world cup wit France na im idol.


Many pipo say di Nigerian footballer face resemble di ogbonge French superstar.


Dat resemblance don open many doors for di young footballer .


Tins begin open up for Emmanuel wen im start to post im and Paul Pogba picture and im training videos for social media few years ago.


Afta Pogba comment for one of im post na im Emmanuel blow, im followers increase to 395k.


For di post, Emmanuel wear Manchester United jersey just like Pogba and for di caption im say, "wen difference no dey between you and Paul pogba".


Pogba comment say "I see you mini me".


But no be only Pogba spot im football talent, brands like Adidas also recognize im football talent.


Adidas send Emmanuel signed Pogba jerseys and football boots.


'Pipo go dey call me Pogba Junior'

E say dat Pogba comment really ginger am to work harder to prove to pipo say aside di resemblance im be good footballer.


Although for now, e no dey play for any club but e dey train every day with di local team for im area to dey match fit.


"So for my area if I dey waka ehn, pipo go dey call me Pogba Junior, little Pogba, mini Pogba, eviritin wey just concern Pogba na im be my name for my area like dis" Emmanuel tok.


Emmanuel come from Anambra state for di south east part of Nigeria but grow up for Lagos with im parents and five siblings.


Growing up, life bin dey ok for di young footballer, e describe eviritin wey don happun to am as blessing.


Wit big smile for im face, Emmanuel tok how Pogba don influence im life.


E say e don learn a lot from Pogba game and fashion style.


"Even for my hair style I still dey copy am sef". Emmanuel tok.


Emmanuel say belle sweet am wen im receive Pogba signed jersey and boots wey Adidas give am sake of im work.


But im mood change wen im start to tok about Pogba four year doping ban.


"As I hear di tori about dat Pogba ban I feel bad becos na Pogba dey motivate me for football like dis. But me as im biggest fan wetin I go do na to motivate am for im lowest moment". Emmanuel tok.


"So for im birthday I do video for am, im even like di post e see di video, I believe say e hear di message wey I send give am". Emmanuel add.


For Emmanuel, im dream na to play football for Europe wit big teams like Manchester United and Juventus and to dey popular like Nigerian legends, Victor Osimhen and Jay Jay Okocha.

Post a Comment

Previous Post Next Post

You'll Love ❤ our Affiliate Disclosure [ Click Ad to Read]]

You'll Love ❤ our Affiliate Disclosure [ Click Ad to Read]]

Inspire Football